Our Terms & Conditions | Our Privacy Policy
139 million pipo dey live inside poverty for Nigeria
Bola Tinubu bi di president for Nigeria
Di Nigerian govment don reject di latest report by di World Bank wia dem tok say poverty for di kontri rise from 40 percent in 2019 to 61 percent in 2025.
Di report wey di title na ‘Nigeria Development Update – October 2025, say di numba of poor pipo from Nigeria increase from 81 million to 139 million by 2025, but e add say “three-quarters of di increase bin occur bifor 2023”.
Nigeria economy, according to report, don dey grow well-well sake of di refprms wey di present administration don put in place, but di growth neva dey enuf.
“Di implemented important reforms since mid-2023… don start to yield tangible results. Growth don increase, di overall fiscal situation don improved due to surge in revenue; di foreign exchange market don dey stable and e still dey consolidate; the external position dey strong wit rising FX reserves and large current account surplus sake of big rise for exports; and inflation don start to dey gradually come down,” di report tok.
However, “despite recent progress, reform gains neva yet translate into ogbonge improvement for di standard of living. Growth neva dey strong enof to create beta jobs, and still-high inflation continue to dey chop real incomes, especially for di poor and economically insecure”.
Food inflation wey dey too high na di ogbonge factor wey di report say na im dey affect di poor pipo more, bicos majority of pipo dey spend almost 70 percent of dia income on top food alone.
For State govments, di report say even though dia revenue from di federation account don increase, dem dey focus more on infrastructure spending, while “funding for education, health, and social protection remain inefficient”.
Govment reject report
Sunday Dare, one of di tok-tok pipo for President Bola Tinubu, respond to di NDU report by di World Bank, and e say dem no put am for proper context.
Dare say di 139 million pipo wey di World Bank dey tok about nobe “literal, real-time headcount”.
“Di govment dey regard di figure as modelled global estimate, no be empirical representation of conditions for 2025. Wetin truly matter na di trajectory – and di trajectory of Nigeria now na recovery and inclusive reform.”
Di tok tok pesin go ahead to list all di tin wey e say govment dey do to reduce poverty for Nigeria.
Dem di Conditional Cash Transfers wey don dey rech more dan 15 million households, di Renewed Hope Ward Development Programme wey dey target all di 8,809 electoral wards for Nigeria, di National Social Investment Programmes such as TraderMoni, MarketMoni, and FarmerMoni, plus odas.
“President Tinubu administration dey committed to reduce di incidence of poverty. Nigeria don reject exaggerated statistical interpretations wey dey detached from local realities,” Dare tok.
In 2019, Nigeria President dat time wey be Muhammadu Buhari say govment dey committed to empower at least 100 million pipo to escape extreme poverty by 2030.
Dis mean say at least 10 million pipo suppose dey comot from poverty evri year from 2020, but dat commitment no work bicos by 2022, di National Bureau of Statistics release report wey say more dan 130 million pipo for Nigeria dey live for multidimensional poverty.
According to di report, Kano State get di highest numba of poor pipo, followed by Kaduna, Katsina, Sokoto, Jigawa, Bauch and Abia States.
Images are for reference only.Images and contents gathered automatic from google or 3rd party sources.All rights on the images and contents are with their legal original owners.
Comments are closed.